Luke 8:47-48
Luke 8:47-48 PCM
Wen di woman si sey e nor go fit hide again, e kom out dey shake kon fall for Jesus front. For evribody present, e tok wetin make am tosh Jesus and how e kon well at wons. Jesus kon tell di woman, “My pikin, yor faith don heal yu. Make peace follow yu.”