YouVersion Logo
Search Icon

John 11

11
Jesus Wake Lazarus
1E get one man, en name na Lazarus and e nor well. En with Mary and Marta, en sistas kom from Betany. 2Na dis Mary pour perfume for Jesus leg, kon klean dem with en hair. 3So di sistas kon send message go meet Jesus sey, Oga God, yor friend wey yu love well-well nor well.
4Wen Jesus hear di message, e kon sey, “Dis sickness nor go kill Lazarus. E go make God and en pikin get honor.” 5(E klear sey Jesus love Marta, Mary and Lazarus well-well.) 6Afta e hear sey Lazarus nor well, e stay where e dey for anoda two days.
7Den e kon tell en disciples, “Make wi go back to Judea.”
8But en disciples ask am, “Tisha, nor bi di place where di Jew pipol won for kill us yu sey make wi go again so?”
9Jesus ansa, “Evriday get twelf hours wey lite dey take shine, so pipol nor dey fear to waka, bikos dem dey si well-well, as e bi sey lite dey. 10But pesin wey waka for nite, go fit fall, bikos e nor get lite to si road.”
11Den Jesus tell dem, “Awa friend Lazarus dey sleep, but I won go wake am up.”
12Di disciples sey, “Oga God, if e just dey sleep, den e go wake-up.” 13(Dem tink sey, wetin Jesus mean bi sey, Lazarus just dey sleep, but wetin e mean bi sey, Lazarus don die.)
14So e tell dem sey, “Lazarus don die. 15I happy sey I nor dey der, so dat una go get anoda shance to bilive mi. Make una kom make wi go si am.”
16So Tomas, (wey bi Twins) kon tell di oda disciple, “Make wi follow am go, so dat wi go die with am.”
Jesus Tok With Marta And Mary
17Wen Jesus rish Betany, dem kon tell am sey e don rish for days wey dem beri Lazarus. 18(Betany na about two mile from Jerusalem, 19and from der, many Jew pipol kon salot Mary and Marta, bikos of dia broda wey die.) 20So wen Marta hear sey Jesus dey kom, e kon waka go meet am, but Mary sidan for house.
21Marta tell Jesus, “Oga God, if to sey yu dey here, my broda nor for die. 22But I know sey, God go give yu anytin wey yu ask am.”
23So Jesus tell am, “Yor broda go wake-up again.”
24Den Marta sey, “I know sey e go wake-up again for di resureshon day.”
25Jesus ansa am, “Na mi bi di resureshon and na mi dey give life. Anybody wey bilive mi go get life even if e don die 26and di pesin wey bilive mi for dis life, nor go ever die. Marta, yu bilive wetin I tok so?”
27Marta kon ansa, “Yes! Oga God, I bilive sey yu bi Christ, God Pikin, wey kom dis world.”
28Den Marta go meet Mary, en sista kon tok for en ear sey, “Di tisha dey here and e won si yu.” 29Wen Mary hear wetin e tok, e kon get up go meet Jesus. 30Jesus still dey outside di village wen Marta go meet am. 31Wen di pipol wey kom salot Mary si as e waka komot kwik-kwik, dem kon tink sey na Lazarus grave e for dey go kry, so dem follow am.
32Wen Mary si Jesus, e fall for en front kon sey, “Oga God, if to sey yu dey here, my broda nor for die.”
33Jesus kon si as Mary and di oda pipol dey kry. So e sorry for dem and di tin pain am well-well. 34E kon ask dem, “Where una beri am put?”
Den dem tell am, “Oga God, kom make wi show yu.”
35Jesus kon kry.
36Di pipol wey kom salot dem kon sey, “Jesus love dis man well-well o-o.”
37But some among dem sey, “Dis man wey make blind man si, e nor fit do make Lazarus nor die?”
Jesus Wake Lazarus From Deat
38Jesus sorry for dem again, den e waka go di grave. (Dis grave na big whole inside rock wey dem take big stone kover). 39Jesus kon sey, “Make una remove di stone.”
Marta wey bi Lazarus sista kon sey, “Oga God, by dis time e go don dey smell, bikos e don rish for days wey dem beri am.”
40Jesus tell am, “I nor tell yu before sey, ‘Yu go si God pawa, if yu bilive mi?’ ”
41So, dem kon roll di stone komot from di grave mout. Den Jesus look heaven kon sey, “Papa, I tank Yu sey Yu dey always hear mi and dey do di tins wey I ask from Yu. 42I know sey Yu dey always hear mi, but I dey tok like dis, bikos of di pipol wey stand here naw, so dat dem go bilive sey na Yu send mi.”
43Wen e don tok dis finish, e kon shaut, “Lazarus, kom out!” 44Den Lazarus kom out, but di klot wey dem take beri am still kover en body.
So, Jesus tell dem, “Make una luz di klot komot for en body, make e dey go.”
Jew Pipol Dey Vex
45Den many pipol among di Jew pipol wey follow Mary go di grave bilive Jesus, wen dem si wetin happen. 46But some among dem go meet di Farisee pipol kon tell dem wetin Jesus do. 47Den di priest oga dem and Farisee pipol kon koll di kansol memba dem togeda, ask dem, “Wetin wi go do, since dis man dey do plenty mirakles? 48If wi let am kontinue like dis, evribody go bilive am and di Roman govnor go kom take di place wey wi dey woship and awa kountry.”
49Den won among dem wey en name bi Kaiafas, wey bi di High Priest dat year kon sey, “Una bi fool wey nor undastand wetin dey happen. 50Una nor know sey e betta make one man die for evribody, dan sey make evribody for dis kountry die?”
51(Dis man tok like dis, bikos naim bi di High Priest dat year. E tok true sey, Jesus go die for di whole Jew pipol, but e nor know wetin e tok, 52and nor bi for only di Jew pipol, but make all God shidren, wey dey di world for gada togeda.) 53So from dat day, dem kon dey plan to kill Jesus.
54Bikos of dis, Jesus nor kon dey waka for Judea as e dey do before, but en and en disciples kon go stay for di town wey dem dey koll Efraim, wey near wildaness.
55Wen Passova Feast don near, many pipol for di kountry go Jerusalem, kon dey make demsef klean for di feast, as dia tradishon tok. 56Dem bigin dey look for Jesus kon dey ask each oda inside di temple yard, “Wetin yu tink, e go kom for di feast?” Abi yu nor tink so? 57(By dis time, di priest oga dem and di Farisee pipol don give orda sey, anybody wey know where Jesus dey, make e kon tok, so dat dem go-go katch am).

Currently Selected:

John 11: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in