Luke 14:28-30

Luke 14:28-30 PCM

“Wish of una wey won build big house, nor go first kakulate weda di money wey e get go rish to finish am? If e nor do so, wen e don lay di foundashon and e nor fit finish di house, evribody wey si wetin happen, go kon dey laf am. Dem go sey, ‘Dis man start to build house and e nor fit finish am!’