Den devil take Jesus go Jerusalem kon make am stand on-top di place where high pass for di temple kon tell am, “If yu really bi God Pikin, make yu jump go down, bikos God word sey,
“ ‘God go tell en angels make dem guide yu’
and,
‘Dem go karry yu for dia hand,
so dat yu nor go use yor leg nak stone.’ ”
Jesus ansa am, “God word sey, ‘Make yu nor test God wey bi yor Oga God.’ ”