Wen Jesus dey for one town, one man wey get leprosy kom meet am. Wen di man si Jesus, e fall face groun kon beg am sey, “Oga God, if yu like to do am, yu go fit heal mi.”
So Jesus tosh di man kon sey, “I like to do am. ‘Oya! Make yor body klean naw!’ ” At wons, di leprosy komot for di man body.