1
Luke 6:38
Holy Bible Nigerian Pidgin English
Make una give pipol wey nor get and God go give una wetin really big, E go pak am well-well and di tins go ova full. God go pour all dis tins for una life. But na as una take give odas, na so God go take give una too.”
Параўнаць
Даследуйце Luke 6:38
2
Luke 6:45
Wen pesin dey good, na di good tins wey dey inside am, dey make am bear good fruits, but bad pesin, na di bad tins wey dey inside am, dey am make bear bad fruits, bikos na from wetin full inside pesin mind, naim en mout dey tok.
Даследуйце Luke 6:45
3
Luke 6:35
But make una love una enemies kon do good and make una nor espect anytin back wen una borrow anybody sometin. Na dis go make God pay una back and una go bi en shidren, bikos God ensef dey do good for wiked pipol and doz wey nor dey sey tank yu.
Даследуйце Luke 6:35
4
Luke 6:36
So, make una dey show mesi, just as una Papa dey show mesi.”
Даследуйце Luke 6:36
5
Luke 6:37
“Make una nor judge oda pipol, so dat God nor go judge una. Make una nor kondemn odas, so dat God nor go kondemn una. Make una forgive odas and God go forgive una.
Даследуйце Luke 6:37
6
Luke 6:27-28
“But I dey tell una wey dey listin, ‘Make una love una enemy and do good to pipol wey hate una.’ Make una bless doz wey curse una and pray for doz wey dey trit una anyhow.
Даследуйце Luke 6:27-28
7
Luke 6:31
Make una do for pipol as una wont make dem do for una.
Даследуйце Luke 6:31
8
Luke 6:29-30
If anybody slap una for face, make una turn di oda side gi-am too. If anybody use force kollect una koat, make una gi-am una shirt join too. Make una give evribody wey ask una for sometin and if anybody take wetin bi una own, make una nor ask for am back.
Даследуйце Luke 6:29-30
9
Luke 6:43
“Bikos betta tree nor dey bear bad fruit and know bad tree dey bear good fruit
Даследуйце Luke 6:43
10
Luke 6:44
bikos na fruit wey tree bear, naim pipol dey take know di kind tree wey e bi. Pipol nor dey plok fig or grape from shuku-shuku tree.
Даследуйце Luke 6:44
Стужка
Біблія
Пляны чытаньня
Відэа