Luke 18
18
Prayer
1Den Jesus tell dem one parabol to show sey, e good make pipol dey always pray. 2E sey, “One judge dey for one town wey nor dey fear God and e nor dey respet anybody. 3For dat town, e get one woman wey en husband don die. E kon go meet di judge kon beg am, ‘Make yu help mi, bikos some pipol dey shit mi.’
4“Di judge nor first listin to am, but afta, e tok for en mind sey, ‘Aldo I nor dey fear God and respet anybody, 5but bikos dis woman dey disturb mi, I go make sure sey e get wetin e suppose get, oda-wise e nor go let mi rest with dis en beggy-beggy wey nor dey finish.’ ”
6Jesus sey, “If di wiked judge tok like dis, 7una nor tink sey God go help en pipol wey dey kry to am both day and nite? Abi, God go wait tey before E help dem? 8I tell una true word, God go help dem kwik-kwik. But wen Man Pikin kom back, e go si pipol wey get faith?”
Di Farisee And Tax Kollector
9Jesus kon tell dis parabol to some pipol wey bilive and feel sey, na dem holy pass and nobody good rish dem. 10“Two men go inside Temple go pray. One na Farisee and di oda one na tax kollector. 11Di Farisee kon stand dey pray about ensef sey: ‘God, I tank yu sey I nor bi like oda pipol wey dey play wayo, dey sin, pipol wey dey kommit adultery or even like dis tax kollector. 12I dey fast two times a week and I dey pay one out of evry ten tins wey I get, give yu.’
13“But di tax kollector stand for far place and e nor even look heaven, but kon nak en chest dey sey, ‘God, make yu sorry for mi, bikos I bi sina!’
14“I tell una true word, na di tax kollector God go forgive, nor bi di Farisee. Bikos anybody wey karry ensef go up, God go bring am down, but di pesin wey put ensef down, God go karry am up.”
Jesus And Small-small Shidren
15Some pipol kon bring dia pikin make Jesus tosh dem. But wen di disciples si dem, dem kon bigin shaut for di pipol wey bring di shidren. 16But Jesus koll di shidren kon sey, “Make una allow di small-small shidren kom meet mi, nor stop dem, bikos na pipol like dem get God Kingdom. 17I tell una true word, anybody wey nor receive God Kingdom like small pikin, nor go enter inside.”
Di Rish Man
18One day, one Jew oga ask Jesus, “Good tisha, wetin I go do to get life wey nor dey end?”
19Jesus kon tell am, “Why yu dey koll mi good? Nobody good escept God. 20Yu know di kommandment dem wey sey, ‘Make yu nor sleep with pesin wey nor bi yor husband or wife, nor kill pesin, nor tif, respet yor papa and mama.’ ”
21Di man ansa Jesus, “I dey obey all dis law with all my heart since I bi small boy.”
22Wen Jesus hear wetin di man tok, e kon tell am, “E still get one tin wey yu neva do, make yu sell evritin wey yu get, give di money to poor pipol, den yu go get betta propaty for heaven. Afta dat, make yu kom follow mi.”
23Wen di man hear dis one, e kon dey vex, bikos e rish well-well. 24Wen Jesus know sey di man dey vex, e kon tell di pipol wey dey with am, “E go hard well-well for pesin wey rish well-well to enter God Kingdom! 25E dey eazy for kamel to pass nidol whole dan for pesin wey rish well-well to enter God Kingdom.”
26Pipol wey hear dis word kon sey, “Den who God go save?”
27Jesus ansa, “Wetin nor possibol for human being, dey possibol with God.”
28Den Pita sey, “Oga God, wi don leave evritin wey wi get kon follow yu!” 29Jesus kon tell dem, “I tell una di trut, anybody wey leave en house, wife, brodas, papa, mama or pikin bikos of God Kingdom, 30God go bless am with wetin pass all di tins wey e leave, both for dis world and for di life wey dey kom.”
Jesus Tok About En Deat Again
31Jesus koll di twelf disciples go korna kon tell dem, “Si, wi dey go Jerusalem and evritin wey di profets rite about Man Pikin go happen for der. 32Bikos dem go gi-am to Gentile pipol and dem go laf, curse and spit for en body. 33Dem go flog am well-well and dem go kon kill-am. But for di third day, e go wake-up.”
34But di twelf disciples nor undastand wetin Jesus tok, bikos God hide wetin e mean from dem.
Jesus Heal Blind Man
35As Jesus near Jeriko, one man wey blind sidan for di road korna dey beg. 36Wen e hear plenty pipol dey pass, e kon ask wetin dey happen. 37Dem kon tell am sey Jesus wey kom from Nazaret dey pass.
38So di man kon dey shaut, “Jesus, David pikin, make yu sorry for mi o-o!”
39So di pipol wey dey en front kon dey shaut for am make e kwayet, but e kon dey shaut more-more, “David pikin, make yu sorry for mi o-o!”
40So Jesus stop kon sey make dem bring di beggar kom meet am. Wen di man kom, Jesus ask am, 41“Wetin yu wont make I do for yu?”
Di man sey, “Oga God, I won si again.”
42Jesus kon tell am, “Make yu si naw, yor faith don heal yu.” 43At wons, di man bigin si and e kon follow Jesus, dey praiz God. Wen di pipol si wetin happen, dem kon bigin praiz God.
Цяпер абрана:
Luke 18: pcm
Пазнака
Падзяліцца
Капіяваць
Хочаце, каб вашыя адзнакі былі захаваны на ўсіх вашых прыладах? Зарэгіструйцеся або ўвайдзіце
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee