Luke 2
2
Dem Born Jesus
1Dat time, Caesar Augustus kon give orda make evribody wey dey Rome go register dia name make dem for pay tax. 2Dis na di first time wey pipol go register, since di time wen Kwirinus bi govnor for Siria. 3Evribody kon go en home-town go register.
4So Josef wey dey stay for Nazaret for Galilee kon travel go Betlehem, David Town for Judea, bikos na David family e from kom. 5Josef and Mary wey e won marry wey get belle, go register togeda. 6As dem dey for Betlehem, time kon rish for marry to born. 7So e born en first son, wrap am kon put am for where dem dey keep animal, bikos know oda place dey for dem to stay.
Shepads Visit Jesus
8Some shepads dey for dat aria, dey kare for dia sheep for nite. 9God angel appear to dem and God glory kon dey shine for evriwhere, den fear katch dem. 10Di angel tell dem, “Make una nor fear! Make una listin well, bikos I kom tell una news wey go make pipol happy. 11Today, dem born una Savior for dis town wey David from kom, en name na Christ, wey bi di Oga God. 12Na dis go bi sign wey una go take know am: Una go si pikin wey dem use klot wrap inside where dem dey keep animal.”
13At wons, many angels appear for heaven kon stand with di first angel dey praiz God sey,
14“Na only God get Glory for heaven and eart,
make peace and favor dey with evribody.”
15Wen di angels go back to heaven, di shepads kon tell each oda, “Make wi go Betlehem go si wetin happen, wey God don show us so.”
16Dem kon go si Mary, Josef and di pikin for inside di animal house. 17Wen dem si am, dem kon tok how di angel take tell dem about di pikin. 18Evribody wey hear wetin dem tok, sopraiz well-well. 19But Mary keep wetin e hear for en mind kon dey tink about am. 20So di shepads go back, dey praiz God, bikos of all di tins wey dem hear and si. Evritin just bi as di angel tell dem sey e go bi.
21Wen di pikin rish eight days, dem sekonsaiz am kon koll am, “Jesus”, di name wey di angel tok before en mama even get belle.
Jesus Dedikashon
22Wen time rish for Mary to present ensef to God, as Moses Law tok, Josef and Mary kon karry Jesus go Jerusalem, go dedikate am give God, 23(as dem rite am for God word, “Evry first-born wey bi boy, dem go gi-am to Mi”), 24and dem go offa sakrifice with two dove or pijin.
Simeon Profesy
25One man dey Jerusalem wey en name bi Simeon and di Holy Spirit dey inside am. Di man dey fear God and dey do wetin God like and e dey wait for di time wen God go free Israel. 26Di Holy Spirit don show am sey e nor go die before e go si di Mezaya wey God promise. 27So God Spirit karry Simeon enter di temple and wen Jesus papa and mama bring am to do wetin Moses Law tok, 28Simeon kon karry Jesus for en hand dey praiz God sey,
29“Naw, as yor word tok,
yu, God wey dey rule evritin,
make yu let yor savant go rest.
30Bikos my eye don si di pesin wey yu won
make e save Israel pipol,
31di One wey yu don prepare
for evribody present:
32Na-im bi di lite
wey go show Gentile pipol road
kon bring honor to yor pipol, Israel.”
33So di pikin papa and mama sopraiz for wetin Simeon tok about am. 34Den Simeon bless dem kon tell Mary, “Listin well-well: God don choose dis pikin to make some pipol for Israel fall and raiz odas up and e go bi sign wey many pipol nor go asept. 35True-true, bikos of am, di sekret tins for many pipol mind go kom out and vexnashon like swod, go shuk dia heart!”
Anna Testimony
36One profetes dey, wey en name bi Anna, Fanuel dota, wey kom from Asher family. E don old well-well and e marry en husband for seven years, before di man die. 37E don rish eighty-four years since en husband die. E nor dey komot for di temple, e dey serve God and dey fast and pray day and nite. 38For dat time, e kom meet Josef, Mary, di pikin and Simeon kon bigin tank God, dey tok about di pikin give evribody wey dey wait for di time wen God go free Jerusalem.
39So, wen Josef and Mary don do all di tins wey God law sey make dem do, dem kon go back to dia house for Nazaret for Galilee. 40Di pikin kon grow, dey strong, e get sense and God favor, dey with am.
41Evry year, Jesus papa and mama dey go Jerusalem for Passova Feast. 42Wen Jesus bi twelf years, dem kon go as dem dey do before 43and as dem dey go back to dia house, Jesus nor follow dem, but en papa and mama nor know; 44bikos dem tink sey e dey among dem wey dey travel togeda. Wen dem don travel for one full day, dem kon dey find Jesus among dia rilashons and friends. 45As dem nor si am, dem kon go back to Jerusalem go find am. 46Afta three days, dem kon si am inside di temple, where e sidan with di tishas dey listin and dey ask dem many kweshon. 47Evribody wey hear wetin Jesus dey tok kon dey sopraiz for di way e undastand and di ansa wey e dey give. 48Wen en papa and mama si am, dem sopraiz well-well. Naim en mama sey, “My pikin, why yu do us like dis? Si, mi and yor papa dey find yu for evriwhere since.”
49Jesus ansa dem, “Why una dey find mi? Una nor know sey I go dey my Papa house?” 50But en papa and mama nor undastand wetin Jesus mean.
51Den Jesus follow dem go Nazaret kon dey do wetin dem tell am. But en mama keep all dis tins for mind. 52Jesus kon dey get sense more-more as e dey grow, so God and pipol like am well-well.
Цяпер абрана:
Luke 2: pcm
Пазнака
Падзяліцца
Капіяваць
![None](/_next/image?url=https%3A%2F%2Fimageproxy.youversionapistaging.com%2F58%2Fhttps%3A%2F%2Fweb-assets.youversion.com%2Fapp-icons%2Fbe.png&w=128&q=75)
Хочаце, каб вашыя адзнакі былі захаваны на ўсіх вашых прыладах? Зарэгіструйцеся або ўвайдзіце
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee

:
Пазнака
Падзяліцца
Капіяваць
![None](/_next/image?url=https%3A%2F%2Fimageproxy.youversionapistaging.com%2F58%2Fhttps%3A%2F%2Fweb-assets.youversion.com%2Fapp-icons%2Fen.png&w=128&q=75)