Luke 3

3
John Di Baptist Ministry
1Tiberius Caesar don dey rule for fifteen years wen Pontius Pilate bi govnor for Judea and Herod dey rule Galilee, en broda Filip dey rule Iturea and Trakonitis aria and Lysanias dey rule Abilene. 2For dat time, na Annas and Kaiafas bi di High Priests. So God kon tok to John, wey bi Zekaraya pikin, for inside wildaness. 3John kon go all di aria wey dey round Jordan River dey prish sey make pipol turn from dia sin kom meet God and make dem baptize, so dat God go forgive dem. 4As Profet Isaya tok for di book wey e rite sey,
“One vois dey shaut for inside wildaness sey:
‘Prepare di way for di Oga God
and make en road strait.
5Evry place wey low,
God go make am high
and evry place wey high,
God go make am low,
bend-bend road go strait,
di road wey bad, go good
6and evribody for dis world go si God salvashon.’ ”
7So John tell di pipol wey kom make e for baptize dem sey, “Una wey bi snake shidren! Who warn una make una run komot from God ponishment wey dey kom? 8Naw, make una bear fruit wey go show sey una don really turn from sin kom meet God, make una nor start to sey, ‘Abraham na awa papa.’ Bikos God fit take dis stones wey dey for groun take make pikin for Abraham! 9Even naw sef, di axe don ready to kut di tree wey nor dey bear betta fruit, dem go kut am down kon trow am inside fire.”
10So di pipol kon ask am, “Wetin wi go do naw?” 11John ansa dem, “Di pesin wey get two klot must give one to pesin wey nor get at-all and di pesin wey get food must share with pesin wey nor get.”
12Tax kollectors too waka kom make John for baptize dem and dem kon ask am, “Tisha, wetin wi go do?”
13John tell dem, “Make una nor kollect money pass di one wey di law tok.”
14Den some sojas kon still ask am, “Wot of us? Wetin wi go do?”
E tell dem, “Make una nor use force kollect money from anybody hand or lie for anybody head and make una salari, rish una.”
15All di pipol kon dey wonder weda John, naim bi di Mezaya wey dem dey wait for. 16John ansa dem, “Na ordinary wota I take dey baptize una, but di pesin wey big pass mi, dey kom, I nor rish who go luz di rope wey dey en shoe. E go baptize una with di Holy Spirit and fire. 17E whole shovel for hand to harvest di korn keep for en store, but e go burn di korn kanda with fire wey nor dey kwensh.” 18Na so John prish di Good News for di pipol.
19But wen John tell Herod wey bi govnor sey, God dey vex with am, bikos of en broda wife, Herodias, wey e marry and all di bad-bad tins wey e do, 20Herod take all dis join di vexnashon wey e get for John, so e kon lock am for prison.
Dem Baptize Jesus
21So wen all di pipol don baptize, Jesus ensef kon baptize too. Wen e dey pray, heaven open, 22di Holy Spirit kom down for en head like dove. Den one vois tok from heaven sey, “Yu bi my Pikin wey I love well-well and yu dey make belle sweet mi.”
Jesus Generashon
23Jesus start en ministry wen e bi thirty years.
Evribody know am as Josef pikin, wey Heli born.
24Heli na Mattat pikin, wey Levi born.
Levi na Melchi pikin, wey bi Jannai pikin and na Josef bi Jannai papa.
25Josef na Mattatias pikin wey bi Amos pikin, wey bi Nahum pikin, wey bi Esli pikin, wey bi Naggai pikin.
26Naggai na Maat pikin, wey bi Mattatias pikin, wey bi Semein pikin, wey bi Josek pikin, wey bi Joda pikin.
27Joda na Joanan pikin, wey bi Rhesa pikin, wey bi Zerubabel pikin, wey bi Shealtiel pikin, wey bi Neri pikin.
28Neri na Melchi pikin, wey bi Addi pikin, wey bi Kosam pikin, wey bi Elmadam pikin, wey bi Er pikin.
29Er na Joshua pikin, wey bi Elieza pikin, wey bi Jorim pikin, wey bi Mattat pikin, wey bi Levi pikin.
30Levi na Simeon pikin, wey bi Judah pikin, wey bi Josef pikin, wey bi Jonam pikin, wey Eliakim born.
31Eliakim na Melea pikin, wey bi Menna pikin, wey bi Mattata pikin, wey bi Natan pikin, wey bi David pikin.
32Jesse wey Obed born, naim bi David papa. Obed papa na Boaz, wey bi Salmon pikin, wey bi Nashon pikin.
33Amminadab wey bi Admin pikin, naim born Nashon. Admin papa na Arni, wey bi Hezron pikin, wey bi Perez pikin wey Judah born.
34Jakob wey Isaak born, naim bi Judah papa. Abraham born Isaak and na Terah wey Nahor born, bi Abraham papa.
35Nahor na Serug pikin, wey bi Reu pikin, wey bi Peleg pikin, wey bi Eber pikin, wey bi Shela pikin.
36Kainan wey Arfaxad born, naim bi Shela papa. Arfaxad na Shem pikin, and Noah wey Lamek born, naim bi Shem papa.
37Lamek na Metuselah pikin, wey bi Enoch pikin, wey bi Jared pikin and Mahalalel wey Kenan born, naim bi Jared papa.
38Kenan na Enosh pikin, wey bi Seth pikin, wey bi Adam pikin and na God kreate Adam.

Цяпер абрана:

Luke 3: pcm

Пазнака

Падзяліцца

Капіяваць

None

Хочаце, каб вашыя адзнакі былі захаваны на ўсіх вашых прыладах? Зарэгіструйцеся або ўвайдзіце