YouVersion Logo
Search Icon

Luke 1

1
Introdushon
1Many pipol don rite di story about di tins wey happen among us, 2as di pipol wey si dem wen dem happen, tell us. 3My oga Teofilus, since I follow evritin from biginnin, I kon tink am sey e good make I rite wetin really happen give yu, 4so dat yu go undastand di tins wey dem tish yu well-well.
Dem Born John Di Baptist
5For di time wen Herod bi King for Judea, one priest dey wey en name na Zekaraya from Abijah family and en wife name na Elizabet, wey kom from Aaron family. 6Dem dey do wetin God like, dey follow all di tins wey God tok for en word. 7Dem nor get pikin, bikos Elizabet nor fit get belle and dem don old well-well.
8E kom rish Zekaraya family turn to do priest work for di temple 9and as dia custom bi, dem kon choose Zekaraya make e enter inside God Temple go burn incense. 10Wen di time to burn incense don rish, all di pipol kon gada for outside dey pray.
11God angel appear to Zekaraya for di altar side near where dem for dey burn incense. 12As Zekaraya si di angel, fear katch am well-well and e kon dey shake. 13But di angel tell am, “Make yu nor fear Zekaraya, bikos God don hear yor prayer. Yor wife Elizabet go born boy pikin for yu and yu go koll am, ‘John.’ 14Di pikin go bring joy and happiness for yu and many pipol go happy well-well wen dem born am, 15bikos God go use am well-well. E nor go drink wine or strong drink, but di Holy Spirit go dey inside am, even before dem go born am. 16E go make many pipol follow God. 17E go first kom with Elijah spirit and pawa, before di Oga God ensef go kom. E go make papa setol with dia shidren and pipol wey nor dey obey God before, e go make dem obey am naw, so dat dem go dey ready to meet am for heaven.”
18Zekaraya ask di angel, “How I go take know sey wetin yu tok so go happen? Bikos mi and my wife don old well-well.”
19Di angel ansa, “I bi Gabriel, wey dey stand for God present and na-im send mi kom tell yu dis Good News. 20But since yu nor bilive wetin I tok so, yu nor go fit tok again, until di day wen dis tins go happen.”
21So di pipol wey dey wait for Zekaraya kon bigin wonder why e stay tey inside di temple. 22Wen e kom outside, e nor fit tok again. Dem kon know sey e don si vishon for inside di temple, bikos e use hand take make sign for dem.
23Wen en time to work inside di temple finish, e kon go house. 24Wen e don tey small, Elizabet, wey bi Zekaraya wife kon get belle and e kon hide ensef inside house for five monts. 25So Elizabet kon sey, “God don do big tin for mi for my old age, E don favor mi for pipol present and E don komot shame for my face.”
Dem Born Jesus Christ
26Wen Elizabet belle don rish six monts, God kon send angel Gabriel go Nazaret, one small town for Galilee, 27go meet Mary. Dis Mary neva ever sleep with man before and na-im Josef wey kom from David family, won marry. 28Di angel kon tell am, “I salot yu o-o! Yu wey God don favor, bikos E dey with yu.”
29But Mary dey fear, bikos of wetin di angel tok and e bigin wonder wetin di greetin mean. 30Den di angel tell am, “Make yu nor fear, Mary, bikos God don favor yu! 31Make yu listin, yu go get belle kon born boy and yu go name am, ‘Jesus.’ 32E go big well-well and dem go koll am God wey dey for heaven pikin and God go gi-am en papa David throne. 33Na-im go rule Jakob house forever and en kingdom nor go ever end.”
34Mary tell di angel, “How dis tins go fit happen, as e bi sey I neva sleep with man before?”
35Di angel ansa am, “Di Holy Spirit pawa go kover yu. So di pikin wey yu go born, go dey holy and dem go koll am God Pikin. 36Si, yor kousin Elizabet don get belle for six monts naw and e go born boy for en old age, even doh dem tok sey e nor go fit get belle. 37Bikos e nor get anytin wey God nor fit do.”
38Mary kon sey, “Yes, I bi God savant, make wetin yu tok so, happen to mi.” Den di angel kon leave am.
Mary And Elizabet
39Afta two days, Mary kon get up rush go Judah 40and e enter Zekaraya house go greet Elizabet. 41Wen Elizabet hear as Mary dey greet am, di pikin for en belle jump and di Holy Spirit kon enter Elizabet body. 42So Elizabet kon sey, “God don bless yu pass evry woman and E don bless di pikin wey dey yor belle! 43Who I bi wey make my Oga God mama kom visit mi? 44Bikos as yor greetin rish my ear, di pikin wey dey my belle kon happy bigin jump. 45And God don bless yu, bikos yu bilive sey wetin E tok, go happen.”
Mary Praiz God
46Mary kon sey,
“My heart go praiz God
47and my spirit dey happy
bikos God, my Savior,
48don si en savant kondishon.
From today go, evribody go sey God don bless mi,
49bikos E don do big-big tins for mi
and en name dey holy.
50E dey show en mesi to evribody wey dey fear am
for evry generashon.
51E don do many big-big tins with en pawa
and E don skata di mind of di pipol dey karry body up.
52E don remove rulers from dia throne and pipol wey bring demsef down,
E don karry dem go up.
53E don make doz wey dey hongry beleful with good food and pipol wey get money well-well,
E don make dem poor.
54E help en savants,
Israel pipol remember en mesi,
55wey E promise awa grand-grand papa dem
and E go show mesi to Abraham and en shidren forever.”
56Mary stay with Elizabet for about three monts, den e kon go back to en house.
Dem Born John
57Di time kon rish for Elizabet to born, so e kon born boy. 58En neighbour and rilashons hear sey God don do big tin for am, so dem kom happy with am.
59Wen di pikin rish eight days, dem sekonsaiz am, won kon gi-am en papa name, Zekaraya. 60But en mama sey, “No, dem must koll am John.”
61Dem kon sey, “But e nor get any of una relashon wey en name bi John.”
62So dem make sign give Zekaraya ask sey, “Wetin wi go koll di pikin.” 63Zekaraya ask for sometin make e rite put, den e kon rite, “En name na John.” So, all of dem kon sopraiz well-well. 64Den Zekaraya mout open and e kon bigin praiz God. 65Fear katch all dia neighbour and for evriwhere for Judea, na di matter dem kon dey tok about. 66So evribody wey hear wetin happen, keep am for dia mind dey sey, “Wish kind pikin dis one go bi sef?” Bikos God dey with am true-true.
67Den di Holy Spirit enter Zekaraya and e kon bigin profesai, dey sey,
68“Make wi praiz Israel God,
bikos E don help and free en pipol.
69E send di Savior wey get pawa kom meet us,
from David family.
70God promise en profet before-before
71sey, wi go dey save from awa enemy
and from pipol wey hate us.
72E do dis tins to show en love for awa grand-grand papa dem
and to remember di promise wey E give dem.
73Even awa papa Abraham sey,
74‘E go save us from awa enemy hand,
so dat wi go fit take all awa heart serve am
75and wi go dey holy and good for en eye
as long as wi dey for dis world.’
76And yu, my pikin, pipol go koll yu God profet
and na yu go-go prepare di road for di Oga God,
77wey go make pipol know sey, God go save dem,
bikos E go forgive dem dia sins.
78Since God love and en kindness strong well-well,
E go let en salvashon rish us,
79so lite go shine for di pipol wey sidan for darkness
and where deat dey.
Den God go give us peace.”
80Di pikin kon dey grow and strong for spirit. E stay for wildaness until di day wen God show am to Israel pipol.

Currently Selected:

Luke 1: pcm

Highlight

Share

Copy

None

Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in