Luke 22
22
Judas Sell Jesus
1Time kon rish for Bread (wey nor get yist) Feast, wey dem dey koll Passova. 2Di priest oga dem and di law tishas dey fine how dem go take kill Jesus, but dem dey fear di pipol. 3So, Satan enter inside Judas Iskariot, one of Jesus twelf disciples. 4E kon go tell di offisa wey dey guide di temple sey e go sell Jesus give dem. 5Dem happy well-well kon promise am sey dem go gi-am money. 6Judas gri and e kon bigin find sekret way to sell Jesus give dem, so dat pipol nor go know.
Di Passova Feast
7Di day for di Bread (wey nor get yist) Feast, wen dem dey kill sheep for sakrifice, kon rish. 8Jesus tell Pita and John, “Make una go prepare di Passova food wey wi go chop.”
9Dem kon ask, “Na for where yu wont make wi prepare am?”
10Jesus ansa dem, “Listin, wen una enter di town, una go meet one man wey karry wota pot, make una follow am enter di house wey e go enter, 11make una tell di pesin wey get di house sey, Di Tisha sey make wi ask yu, ‘Where di room wey mi and my disciples go for chop di Passova food?’ 12E go show una one big room where tabol and chair dey for upstair. Make una prepare evritin for der.”
13Wen dem go, dem kon si evritin as Jesus tell dem sey e go bi, so dem prepare di Passova food for der.
Di Last Evening Food
14Wen di time rish, Jesus sidan for where dem dey chop and en disciples kon join am. 15Jesus tell dem, “I really won chop dis Passova food with una before I go sofa. 16Bikos I tell una, I nor go chop am again, until evritin don komplete for God Kingdom.”
17Den Jesus take one cup wey get wine, afta e tank God, e kon sey, “Make una take dis cup and divide am among unasef. 18Bikos I tell una, from naw go, I nor go drink dis wine again, until God Kingdom go kom.”
19Den Jesus take bread, afta e tank God, e divide am kon gi-am to dem sey, “Na my body bi dis, wey God don give una. Make una dey always do dis tin to take remember mi.”
20Like dat, Jesus still take di cup afta dem don chop finish kon sey, “Dis cup wey God give una, na di new agriment with my blood.”
Last Word
21“I wont make una know sey, di pesin wey go sell mi give my enemy dey chop with mi for dis tabol. 22Bikos Man Pikin go die as God plan am, but curse dey for di pesin head wey go sell am!” 23So di disciples kon bigin ask each oda wish of dem go sell Jesus.
Who Big Pass
24Dem kon dey kworel among diasef sey wish of dem big pass. 25So Jesus tell dem, “Gentile kings dey give dia pipol orda, yet di pipol still dey koll dem, ‘Pipol Friends.’ 26But una nor suppose to bi like dat; di pesin wey big among una, must do like sey naim small pass and di leader, go bi like savant. 27Na who big pass? Na di pesin wey sidan for tabol dey chop or di pesin wey dey serve am? Nor bi di one wey sidan for tabol? But I dey do like savant among una. 28Na una stay with mi wen I dey pass thru wahala. 29So, I give una pawa to rule, just as my Papa don give mi. 30For my kingdom, una go sidan chop and drink for my tabol and una go sidan for difren thrones dey judge di twelf tribes for Israel.
31“Simon! Simon! Make yu listin! God don allow Satan make e test all of una, so dat God go fit separate bad pipol from di good ones. 32But Simon, I don pray for yu make yor faith nor for fail. Wen yu don turn back kom meet God, make yu help yor brodas too.”
33Pita tell am, “Oga God, I dey ready to follow yu go prison and even die with yu.”
34But Jesus sey, “Pita, make I tell yu di trut, fawol nor go do ‘Kukuruku’ dis nite until yu don tok three times sey yu nor know mi.”
35Den Jesus tell dem, “Wen I send una go out, without money, bag or sandals, e get anytin wey una nid wey una nor get?”
Dem ansa, “No!”
36E kon tell dem, “But naw, pesin wey get money or traveling bag must karry am. And pesin wey nor get swod must sell en klot kon use di money by one. 37Bikos I tell una, wetin dem rite for God word about mi must happen sey, ‘Dem kount am join criminals.’ Bikos wetin God rite about mi dey happen naw.”
38Di disciples kon sey, “Oga God, si two swod for here.”
Jesus ansa, “E don do.”
On-top Mount Olives
39Den Jesus komot, kon waka as e dey always do, go Mount Olives and en disciples follow am. 40Wen dem rish der, Jesus kon tell dem, “Make una pray so dat una nor go fall enter temptashon.” 41Den e leave dem, waka go far small, kon knee down dey pray, 42“Papa, if yu like to do am, make yu let dis sofa cup pass mi. But make e bi as yu wont, nor bi as I wont am.” 43One angel appear from heaven kon give Jesus pawa. 44Bikos Jesus dey struggol well-well for mind, e pray sotey en sweat kon bi like blood.
45Wen e pray finish, e go meet en disciples kon si sey dem dey sleep, bikos dem don taya well-well. 46So Jesus tell dem, “Why una dey sleep? Make una get up pray, so dat una nor go fall enter temptashon!”
Dem Arrest Jesus
47As Jesus still dey tok, at wons, some pipol waka kom and na Judas lead dem. E waka go meet Jesus kon kiss am for face. 48So Jesus ask am, “Judas, na kiss yu take sell Man Pikin?”
49Wen doz wey dey near Jesus si wetin won happen, dem ask am, “Oga God, make wi use awa swod?” 50Den one among dem attack di priest savant kon kut en rite ear komot.
51But Jesus shaut for am make e stop, den tosh di man ear kon heal am.
52Den Jesus ask di priest oga dem, di ofisas wey dey guide di temple and di eldas wey kom meet am sey, “Una karry swod and wood like sey una dey kom arrest tif? 53Since wen I dey with una for di temple una nor arrest mi. But na una time bi dis, di time wey darkness pawa go rule.”
Dem Kondemn Jesus
54Den dem arrest Jesus, karry am go di High Priest house. But Pita dey follow dem for back-back. 55Wen dem don make fire for di kompond centre kon sidan togeda, Pita sidan with di pipol too. 56One savant girl si Pita sidan near di fire, e look am for eye kon sey, “Dis man bin dey with Jesus too o-o.”
57But Pita sey, “Woman! Nor bi mi, I nor know am.”
58Afta sometaim, anoda pesin si am kon sey, “Yu dey with dem, nor bi so?”
But Pita sey, “My friend! I nor dey with dem o-o.”
59Wen one hour don pass, anoda pesin kon sey, “I sey dis man dey with dem, bikos en too kom from Galilee.”
60But Pita sey, “Oga God! I nor know wetin yu dey tok.” At wons, as e still dey tok, naim one fawol do, “Kukuruku!” 61Den Jesus turn look Pita for eye and Pita kon remember di word wey Jesus tell am, “Before fawol go do ‘Kukuruku!’ dis nite, yu go don tok three times sey yu nor know mi.” 62Den Pita go outside, bigin kry.
63Di guards bigin laf Jesus kon dey beat am anyhow. 64Dem tie en eye kon dey ask am, “Oya profesai! Na who nak yu so?” 65Dem still curse am with difren words.
66Wen morning rish, di eldas with di priest oga dem and di law tishas kon gada. Den dem take Jesus go dia kansol 67kon tell am sey, “If yu know sey na yu bi Christ, make yu tell us.”
But Jesus ansa, “If I tell una, una nor go bilive mi 68and if I ask una kweshon, una nor go gri ansa. 69But from naw go, Man Pikin go sidan for God rite hand where pawa dey.”
70All of dem kon ask, “So, yu bi God Pikin?”
Jesus ansa, “Na una tok am o-o.”
71Den dem kon sey, “Why wi nid anoda witness? E don tok evritin by ensef!”
Currently Selected:
Luke 22: pcm
Highlight
Share
Copy
Want to have your highlights saved across all your devices? Sign up or sign in
© 2019, Wycliffe Bible Translators, Inc. in cooperation with The Nigerian Pidgin Translation Committee