1
Luke 22:42
Holy Bible Nigerian Pidgin English
“Papa, if yu like to do am, make yu let dis sofa cup pass mi. But make e bi as yu wont, nor bi as I wont am.”
Compare
Explore Luke 22:42
2
Luke 22:32
But Simon, I don pray for yu make yor faith nor for fail. Wen yu don turn back kom meet God, make yu help yor brodas too.”
Explore Luke 22:32
3
Luke 22:19
Den Jesus take bread, afta e tank God, e divide am kon gi-am to dem sey, “Na my body bi dis, wey God don give una. Make una dey always do dis tin to take remember mi.”
Explore Luke 22:19
4
Luke 22:20
Like dat, Jesus still take di cup afta dem don chop finish kon sey, “Dis cup wey God give una, na di new agriment with my blood.”
Explore Luke 22:20
5
Luke 22:44
Bikos Jesus dey struggol well-well for mind, e pray sotey en sweat kon bi like blood.
Explore Luke 22:44
6
Luke 22:26
But una nor suppose to bi like dat; di pesin wey big among una, must do like sey naim small pass and di leader, go bi like savant.
Explore Luke 22:26
7
Luke 22:34
But Jesus sey, “Pita, make I tell yu di trut, fawol nor go do ‘Kukuruku’ dis nite until yu don tok three times sey yu nor know mi.”
Explore Luke 22:34
Home
Bible
Plans
Videos