“Difren-difren signs go show for sun, moon and star. For inside dis world, pipol for difren kountries go dey worry and fear, bikos of di way rivers go dey move and wota go dey rush from sea enter land. Pipol go dey faint and fear go dey katch some, bikos of wetin dey happen for di world and difren pawas inside di sky, go shake komot for where dem dey. Den, dem go si Man Pikin dey kom inside kloud with pawa and glory.