1
Exodus 20:2-3
Holy Bible Nigerian Pidgin English
pcm
“Na mi bi di Oga una God wey take una komot from Egypt, where una for bi slave. Make una nor serve any oda God apart from mi.
Kokisana
Luka Exodus 20:2-3
2
Exodus 20:4-5
Make una nor do any image like wetin dey heaven, eart or inside wota. Make una nor bow or serve dem, bikos na mi bi di Oga una God and I dey jealous well-well. I bi God wey dey ponish shidren and dia shidren-shidren, bikos dia papa Rijet mi.
Luka Exodus 20:4-5
3
Exodus 20:12
Shidren! Make una respet una papa and mama, so dat una days for di land wey di Oga una God dey give una, go long well-well.
Luka Exodus 20:12
4
Exodus 20:8
Make una remember to keep di Sabat Day holy.
Luka Exodus 20:8
5
Exodus 20:7
Make una nor use di Oga una God name take make yeye, bikos I go ponish anybody wey do like dat.
Luka Exodus 20:7
6
Exodus 20:9-10
Una get six days to do all una work, but for di sevent day wey bi di Oga una God Sabat Day, make nobody do any work; both una, una shidren, una savants, una animals or di strenjas for una kountry.
Luka Exodus 20:9-10
7
Exodus 20:17
Make una nor get long-trot for una neighbour propaty; en wife, savants, melu, donkey or anytin wey bi en own.”
Luka Exodus 20:17
8
Exodus 20:16
Make una nor lie for una neighbour head.
Luka Exodus 20:16
9
Exodus 20:14
Make una nor sleep with who nor bi una husband or wife.
Luka Exodus 20:14
10
Exodus 20:13
Make una nor kill.
Luka Exodus 20:13
11
Exodus 20:15
Make una nor tif.
Luka Exodus 20:15