1
John 4:24
Holy Bible Nigerian Pidgin English
God na Spirit and di pipol wey won serve am, must serve am for di true way wey God Spirit go show dem.”
Yenzanisa
Ongorora {{vhesi}}
2
John 4:23
But di time dey kom and e don even rish, wen di pipol wey won really serve God, go serve am for di true way, wey God Spirit go show dem.
3
John 4:14
But anybody wey go drink from di wota wey I go gi-am, nor go hongry for wota again, bikos di wota wey I go gi-am, go turn to river wey nor dey dry inside en belle and di wota go gi-am life wey nor dey end.”
4
John 4:10
Jesus ansa am, “If yu know wetin God gift bi and di pesin wey dey ask yu for wota so, yu for ask am and e go give yu di wota wey dey make pesin live forever.”
5
John 4:34
Jesus kon tell dem, “My food na to do wetin my Papa tok and make I finish di work wey E send mi.
6
John 4:11
Di woman ask am, “Oga God, yu nor get bucket and di well deep well-well, where yu go fit get dat kind wota?
7
John 4:25-26
Di woman ansa, “I know sey di Mezaya (di one wey dem dey koll Christ), wey go save evribody, go kom and anytime wen e kom, e go tell us evritin.” Jesus kon tell am, “Na mi wey dey tok to yu so, bi di Mezaya.”
8
John 4:29
“Make una kom si one man wey tell mi all di tins wey I don do. Dis man nor bi di Mezaya so?”
Pekutangira
Bhaibheri
Zvirongwa
Mavideo